Images
Wetin we call dis foto,How much you want AI to know about you?
AI don dey get personal - Zoe Kleinman, BBC Technology Editor
As AI tools move into our phones – Apple, Google and Samsung all don launch services wey fit edit photos, translate languages and carry out web searches – we dey for di start of time wey AI go become a key part of our digital lives and e go increasingly dey helpful on a personal level.
Dat na if we allow am.
Make we take diary management as an example. AI tool fit manage your diary for you, if you allow am to access am. But how far dis one go go?
In order to dey truly useful, e mean say e also need to know who you go rather avoid meeting, or relationships you wan keep secret, and from whom?
AbI you want am to provide you with summaries of counselling sessions, or medical appointments?
Dis na deeply personal information, and fit dey very embarrassing and valuable if some error mean say e dey shared. You fit trust di big tech firms with dat kind of data?
Microsoft don dey push hard at dat particular door. E enta trouble for 2024 for dia demo of a tool called Recall, wey take snapshots of laptop desktops evri few seconds, in order to help users locate content dem don see but no fit remember wia.
Now, dem don make a number of changes to di product – wey dem no even launch – but stand by am.
“I think we dey move to a fundamentally new age wia dia will be ever present, persistent, very capable co-pilot companions in your evriday life,” di firm head of AI, Mustafa Suleyman tell me recently.
Despite di challenges, Ben Wood, chief analyst for technology research company CCS Insight, expect say more personalised AI services go come out for 2025.
"Di output go continuously dey updated by drawing on evolving data sources, such as emails, messages, documents and social media interactions.
“Dis go allow di AI service to dey tuned specifically to pesin communication style, needs and preferences," e tok.
But Mr Wood accept say letting AI loose on your personal information go be a big step.
You must be logged in to post a comment.